|
Post by MrsVic on May 10, 2006 13:12:14 GMT -5
"THE LORD'S SHEPHERD"
The Lord na mai Sheperd, I dey kampe He make me sidon for where better dey flow and come put me next to stream make my body thermocool. He panel-beat mai soul come spray am white, come dey lead me go through the express road of righteousness for Hin name. Walahi, if i waka pass where arm robber, 419 and juju borku, come even join okada reach valley wey the shadow of death dey, mai body dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so dem dey like backbone dey comfort me. You don prepare banga and starch make i chop. All mai enemies dey look like lucozade and anyanya as i dey chop. You come rub me for head with vaseline intensive lotion. My cup na Ogunpa river wey dey overflow hin bank. Tru true, better life and plenty mercy go gum mai back till i quench. And man go tanda for God house for yonda sotey from lai lai to lai lai. God Almighty, na you biko. Amin!
|
|